MY ENTRY INTO NAIJAPIDGIN'S OGBONGE CONTEST FOR 6 PEOPLE TO WIN 15SBD. THIS NA MY 'BLIND DATE EXPERIENCE'.

in #naijapidgin7 years ago

First of all, i go like thank una very very well for carrying this contest come drop for the front of my domot. I really appreciate wetin #naijapidgin dey do for our lives. Na so so contests and challenges dem dey bring come nak for everybody domot. Na God go bless una for all una deeds.

Now, back to de matter wey carry me come here, na me dem dey call Caesar Peterz, the guy dey get plenty swag for body and I no dey dull for anything at all. All the girls for my area know me wella and I still dey run my shit on a lowkey sha.

20180430_002117.jpg

This tori wey I wan tell una don tey sha. E happen around 2014 wen i still dey js3 for secondary school. That time na im I been dey worry, no be now wey e come be like say I don hang shoe. That time anywhere wey I dey, na woman matter we go always dey talk about. The worst thing be say i no de even follow my age mates talk. Na my seniors i dey like talk with mostly. E come even reach de extent wey be say I come extend my activities to social networks like dem 2go, Eskimi and facebook.

Na so one day i come meet one very fine girl for facebook that time, this girl too fine for her profile picture sotey I start to dey dream about her for my dream everyday. I don forget weda na me add her or na she add me sef, but wetin I know be say somebody add and another person accept. Lol.

For de 1st day we chat very well ehn to de extent wey be say sleep no gree carry me again. We just introduce ourselves to each other on this 1st day. Na so my body just dey sweet me as I drop my phone to sleep that night.

De second day, i ask this girl make she become my one and only, i no believe say this girl fit agree to my request dey but her answer na 'yes. My brothers and sisters, na so I start to dey date person wey I never see before for my life. We no dey even stay for de same town sef but na de same state we been dey sha.
I been dey makurdi that time when this thing been dey happen and she been dey one town wey dem dey call am GBOKO. I no go like call her name here before e go kum be say she dey here dey read my post.

Na so ooo, our blind love come dey grow like wetin I no know. Small time na, she come dey talk say she go like make we meet. I tell am say ok we go meet when school go on holiday. Holiday come reach na, she come tell me say go come visit her aunty dey dey live for inside makurdi town. For inside my mind I just dey happy say I go meet this fine girl wey I just meet for facebook.

After every every, my country people, this girl finally land makurdi. Immediately as she reach park, she just put me on call tell me say she just dey arrive, na she come even fix date dey she go like make we meet. De day wey she fix na Sunday.

When that Sunday reach na, i just go church that day come back with that appointment for the back of my head. After the service, i just go back house, refreshn myself up, then tell my parents say I wan go see my classmate for another region wey dey for makurdi. Them just tell me say make I come back early ooo.

So i come put the girl on call tell am say I don ready for our movement ooo, she tell me say she dey do a already de wait for me. I just enter bus go the venue as I reach there I just standa for road the look for diz girl wey I come look for.

Omoh wetin I see no be wetin I expect. The kind pimples dey full this babe face no be here. Just be like say dem get pimples meeting for her face. Omoh i see something tire that day. The girl leg just dey big like gbango yam. How I wan take know when e be say na just her face and some part of her body she dey snap all the time with all these apps wey dey beautify person face in those days like picmix. No wonder all her pics dey always get that sign under am. Honestly, my spirit weak when I see all these things. Upon say the girl big like gbango yam, she come get K-leg add on top. I just dey confused as I see her. The only thing wey just good for her body na her boobs. But as a guy man wey I be na everything gat dey complete before I start to dey role with you. I just pretend like say I dey happy to sit down with her that day. After that day, i no come believe in that thing called 'blind love'.

Thanks to the #NAIJAPIDGIN'S team for giving me the opportunity to express myself in our acceptable language.

Sort:  

Lol! This guy you funny oo

Abi??? My body just dey sweet me as you like am...thanks for stopping by

Lol, I tell you! But k leg make sense o

LMAO....thanks for stopping by bro

Lol... .....
This you tori make sense wela. Love is blind na.. Forget the pimples

😂 Lol....
This Tori make sense die.
This una love get as e be shaaa.

Lol...big bro thanks for stopping by

guy u no go kill me with laughter.. Especially the part wey u say the only part wey good for her body na her boobs.😂😂

Na true sha,, no be lie....thank you very much for supporting

Abeg no do make I laugh for ground o. No be been fine free love online?

Lol...me sef de thing tire me

Hahahahahahahahaha. You're a comedian o

Lol...how we go do na?