You are viewing a single comment's thread from:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #63 - "RELATIONSHIPS"

in Speak Peacelast year

Mesef don come oooo... I bring agbado, epa, boli with plenty supplements con yia.

This relationship suntin no easy abeg but as per say you be human, you mustt to de for one. Either na with your maale and paale abi friends. If na fine orolistic bobo you find abi otutupoyoyo baby all na ship.

To sail any ship for this life ehn, person gats to work together if una no wan fall yakata do kerewa for water.

Any person wey tink se e right everytime abi de too serious with hin life no near me oo. Na beta deal breaker. Talk sorry first no go kill you especially women. Ona shakara too much abeg. Small talk, water don full face. Say sorry jhoor ogbeni. Make ona de kind to onasef. De caring broda leave work small. Put your partner first. Make ona joli.

Any person wey too de tush abi like to be form anyhow make e no near me. Aunti na "fork" ooo no be "fake". Make we de try get sense as that one na anoda deal breaker.

Sincerity no go kill you. Talk as you de feel for any ship. No de nod to everything wey I talk like fan. Get sense to reason make we yarn togeda. If I no do well tell me. No hail me for rubbish.

Make communication and understanding be the oga patapata of everything. No de look like zombie abi you don use your heart do giveaway?

For the distanceship suntin, I say make ona understand unasef. Make d relationship matter foundation be on trust and make the trust de grow. De talk true. Nobody go be at you. Na relationship you de no b wrestling mania.

Respect each other and make ona love de grow. Turn your guy abi girl to gist partner. Make amebo de flow left and right. Pray together(phone de) make una build onasef. Distance no b barrier. Make tins work. Bring beta suggestion. No de use WhatsApp sticker talk when intelligent conversation de on. Respect yourself make people no say person don take you. You no de market again.

Truth be say, as humans wey we be. We sabi d right tins. Do them abeg my hand don de pain me. Wos alaye. Na you carry my Boli for yia?