Sometimes I dey think say this 24 hours wey we dey get no dey enough at all. Before you know, morning don turn night, and I go dey ask myself wetin I even use the whole day do. So when I see this topic, I smile because e really make sense. If dem fit add 12 more hours to every day, e go really change a lot of things for me
source
First of all, I go use some of the extra time rest well. Honestly, I no dey sleep well as I suppose. Sometimes na 4 to 5 hours sleep I dey get, and e dey affect my mood and energy during the day. If I fit get like 3 or 4 extra hours to sleep every night, I believe say my body go thank me
Then I go use the remaining time chase some things wey I don dey push go front for long. I get small business wey I dey try build online, but because of work and other things, I no dey get time to focus on am. With 12 more hours, I go dedicate like 4 to 5 hours everyday to work on my business, learn more about digital marketing, and even try learn new skills like video editing or UI/UX design
Another thing be say, I go try spend more time with family and friends. Life no be only about hustle and money. Sometimes person go just dey too busy, we forget the people wey dey important for our life. I go use some of those hours just dey gist, laugh, and even go out small. Those little moments dey help person mental health too
Now the big question be if e go make me more productive or if e go slow me down. For me, I believe say e go make me more productive. But I know say e go depend on how person take use the time. If I just use am sleep, press phone or watch movie from morning to night, then e no go really add value. But if I get plan, and I discipline myself, the extra time fit help me achieve more things wey go push my life forward
To be honest, sometimes time no be the real problem, na how we dey manage am. Even with 24 hours, some people dey do wonders. But with 36 hours, I believe say I fit do better, if I really plan my day well
So yes, if dem add 12 more hours to everyday, I go use am rest more, hustle better, and love more. Life na balance. I go try balance everything well, so that the extra time go really help me grow
Posted Using INLEO
Resting is very important, I agree with you on that . Sometimes we work all days that we don't even remember to rest very well in a day so if more time is added, it will give us extra resting time
Yeah it will... I'm sure you will also wish to have more time to rest as well