Oya na, another one tun ti zeh.
The frontend wey I use when I join Hive na Peakd. Everything about am just dey give me joy. If I dey write my post like this, I go dey see the preview for down. I use Peakd for a very long time before I even reason another frontend.
Na person tell me say make I dey use Ecency sef. At first, I no too feel am because after I write finish, I go dey close one eye before I go fit preview wetin I write but as time goes by, I con fall in love with Ecency sef, especially that favorite author thing wey go help me quick see some posts.
Inleo, I use that one sef small. Them sef help my life. I been wan do their premium o but wetin be my net worth.
I love all these frontend but na Peakd I still feel comfortable with. Na Peakd dey help me if I wan correct something. Sometimes wey I go mix up the tags, wey some suppose come first, Peakd go help me just use my hand move am to where he suppose dey.
@Julti1985 abeg come back, you will enjoy this. @balikis95 @ellizy @dwixer @patienceakpan make una come join o.
All join, all way nah way. Na every frontend get him own positive and negative side.
Abi o
Naso
I go reason my own later. Thank you for the take, you sef try
Hahaha. Okay na.
No wahla we go com join you
I go dey wait.
🤣 you are so funny.
😃😃😃😃 abi na.
Guyyy! That’s just it o. Peakd na just the best Frontend for me when e come to edit and write my post. As I Dey see Wetin I Dey write for down e Dey give me joy nor be lie, hehe.
Wait oo
My hopy😃😍😍🤣🤣🤣...which one u come like pass
One of your eyes still dey for our Peakd oo ..lol..and another part of your heart dey fur ecency 😃😃
Na Peakd I like pass all of them. I just dey manage the rest make he no be say I no care about them 😃😃😃
Chaied! It’s the manage them for me. 😂
😂😂😂😂
It is well with the rest that you are managing. 🤣
Ahh! My eyes Dey everywhere good, mama. 😂🥰🥳👀
You are doing well 😍
Thank you, mama. 🥰
As in, I go dey write up dey see am for down. Best feeling ever. Peakd all the way 😍😍😍😍
Yes o. I agree. 🤭
Hahaha 🤣🤣🤣🤣
I couldn't hold the laughter at this point ..lmao
Net worth needs to be calculated first before premium oo🤣🤣
Na so o before I go dey cry premium tears.
I don't want to risk am oo😃
Okay so yeah I like the Peakd site too, especially when writing you would be able to check preview for errors easily.
You are doing well ehn